Wednesday, November 25, 2026 | Global Live Network
WATCH LIVE TV
BREAKING
Global Leaders Convene in Geneva to Finalize Historic AI Governance Treaty ๐Ÿ”ด HOT360 LIVE: Real-Time Verified Breaking News | International Video Broadcasts | Hot360 Radio 98.7 FM Online Stream
Crime & Law 4 min read

Ghana Police K-9 unit: Lance Corporal Chloe and di oda dogs wey dey help fight crime - BBC

Pesin go ask say wetin concern man about dog wey dey trend for social media? Well, dis no be ordinary dog. Dis na Ghana police service dogs wey dey help di kontri fight crime. Last week, photo of one of di dogs begin...

Ghana Police K-9 unit: Lance Corporal Chloe and di oda dogs wey dey help fight crime - BBC
Official Hot360 Story Flyer • Verified Editorial Broadcast

Pesin go ask say wetin concern man about dog wey dey trend for social media?

Well, dis no be ordinary dog.

Dis na Ghana police service dogs wey dey help di kontri fight crime.

Last week, photo of one of di dogs begin dey trend.

Di dog wear police costume wit socks and leash wia one police man dey take am waka.

One popular social media influencer for Ghana, Nana Tรฉa share di picture wit caption say โ€œChai.. dis na di most privileged dog for di kontri right now. Im dey wear socks.โ€

Na so pipo now dey share di photo, odas just dey comment for di post.

But wetin we know about dis dog and why e dey trend?

• Katsina State govment suspend Emir of Daura sake of alleged sexual assault

• Why Nigeria ban di use of Dr prefix for pipo wey no earn am from school

• Nigeria govment introduce new changes to Waec, Neco exams to stop malpractice

• Court for Iran sentence singer to 74 lashes say she perform without hijab

End of Di one wey oda users dey read well well

E be lance corporal Chloe.

One of 49 sniffer dogs wia dey for di K9 unit of di Ghana police service.

As you see am so, na proper trained dog.

Lance corporal Chloe den im oda colleagues don dey help di police carry out different tasks.

Di K9 unit get about five breeds.

Di unit get German shepherd, Belgian malinois and Rottweiler.

Di odas be coca spanion and Dutch shepherd.

Wetin be di duties of di sniffer dogs

Wia dis foto come from, Ghana Police Service

Di dogs dey carry out detection of explosives and narcotics.

Some also dey fit detect money wey dem hide for inside luggage.

Lance Corporal Chloe and im colleagues also dey fit detect weapons for cars, houses or oda places.

Since di police don establish di K9 unit, di dogs don dey help for highway patrols.

Sometime in October 2021, di service deploy di dogs to various places for di kontri to increase visibility.

For one statement di police release dat time, dem tok say โ€œdi dogs dey help track contraband goods wey dey improve oda aspects of criminal investigationsโ€.

For di last few months, di police don dey use di dogs to conduct searches for di airport and oda lorry stations.

Some of di dogs also dey help for controlling crowd.

Di ranks wey di dogs get

Wia dis foto come from, Ghana Police Service

Just like e dey for normal police service, so also di ranking system dey for di sniffer dogs.

Di service dey promote dem based on years of service and good conduct.

LCpl Chloe don chop over four years for di service.

Odas among di 49 be corporals and sergeants.

Di ones wit di highest rank na Inspector Ragna and Inspector Hunter.

For di K9 unit, di pipo wey dey handle dis dogs na proper Ghana policemen and women wia dem train for South Africa.

Di Inspector General of Police, Dr George Akuffo Dampare tok say di unit be one area im never dey take am lightly.

According to di IGP, di way โ€œcriminals don make sophisticated, na so di police also dey upgrade to match dem boot-for-boot.โ€

Afta one operation di police dey call โ€œwho let di dog outโ€ for 2021, wey allow di men and di dogs enter communities to enhance visibility and crime-fighting, di service say tins dey better.

Wia dis foto come from, Ghana Police Service

Na so on 22 November for di 52nd cadet officers graduation wey happun for Accra, di police parade di 49 dogs.

For di IGP, dis na to show say di unit don dey firm to do dia work, especially as di festive season dey come wey plenti pipo go come di kontri for holidays.

LCcpl Chloe and im oda colleagues don dey ready whenever dia bosses go call dem.

Quick Story Answers

What is the latest update on: Ghana Police K-9 unit: Lance Corporal Chloe and di oda dogs wey dey help fight crime - BBC?
Pesin go ask say wetin concern man about dog wey dey trend for social media?
Where can I read the full Crime & Law report and watch updates?
Well, dis no be ordinary dog. Verified coverage is published on HOT360 ONLINE TV (hot360onlinetv.top).
280 readers

Related Stories

Reader Comments (0)

Join the Conversation
No comments yet. Share your thoughts above!
LIVE ON-AIR Hot360 Pulse Live FM 98.7 FM
Continuous Live Broadcast Stream • Click to tune in
Radio Portal
NON-STOP READER News Story 1
Ready to read all news non-stop...
Press Play to start continuous news audio broadcast.